Ghana and South Africa don agree say ordinary passport Ghanaian holders go fit travel enta di kontries without visas.
Dis waiver be for ordinary passport holders say dem go fit travel to and from both kontris without visas for 90 days each year.
For one statement di foreign affairs ministry for Ghana release, goment tok say “di agreement dey take effect from 1 November.”
“Travelers go transit through, depart from and stay for di territory of Ghana and South Africa for 90 days without recourse to work."
If di 90 days come finish within di 12 months period, di ordinary passport holders go den need to apply for visa to enta SA, one statement from South Africa High Commission for Ghana also tok.
Before now, Ghanaians dey need visa to enta South Africa.
Pipo for South Africa also dey need visa to enta ghana.
Ghanaians no dey qualify for visa on arrival before, so pesin for apply and obtain visa for Ghana from di South African embassy wey dey Accra.
Dis process dey fit take weeks to months, sake di embassy dey under pressure wit plenti applications.
Ernest Apraku tok BBC Pidgin say di last time im travel to South Africa on holidays, im get e visa afta two months wey im apply.
“From di time I don apply for di VFS visa application center to wen di visa make ready, na two months, one week.”
For Ernest, di new regime mean say di stress wey e for go through no go dey again.
Im go save di $280 (GHC 3,300) wey e go pay as visa fees on average.
Ernest also make happy say “di inconvenience no go happun again if di new system don start.”
In September dis year, one comedian for di kontri, OB Amponsah miss chance say im den one of im colleagues for go South Africa.
Even though na comedy show dem wan attend, di visa processes frustrate dem well well.
OB Amponsah vent for social media say, “afta we work hard for di gig for one festival for Bloemfontein, we no fit go sake of di frustrating visa processes.”
Dis fresh 90-day visa waiver even though e no dey cover work-related travels, OB Amponsah say na good move.
“Dis move dey feel good. Di president and im pipo try for dis one,” im write for Facebook afta di announcement.
Wit di new regime for both kontris, Jubulani Sithole go fit move in and out for Ghana without visa for at least 90 days per year.
As e come Ghana last month, im spend $1,300 (GHC 15,000) for ticket and $280 (GHC 3,300) for visa.
In all, di adventure enthusiast spend $1,580 (GHC 18,600) before im enter Ghana.
Jubulani tok BBC Pidgin say “after 1 November, I no go spend that kind moni for visa. Dis be good move.”
Jubulani dey Ghana for anoda three weeks before im go go back to SA.
E no be im alone happy about di visa waiver.
Many odas say na great initiative as di continent dey struggle to remove barriers wey dey affect travels inside Africa.
Event organizers for Ghana dis Christmas already dey make plans for guests from SA.
Ghana tourism ministry don launch ‘December in Ghana 2023’ wia go see plenti pipo come to Ghana for concerts and oda christmas festivities.
Di ministry and di tourism authority “dey expect say di ‘December in Ghana’ go exceed expectations and go make Ghana a top cultural and tourism destination.”
If Jubulani and odas wan come di kontri for di December events, di only tin dem for prepare for be ticket fees and accommodation arrangements
wellspring:BBC NEWS
Post a Comment