Super Eagle fly high and score again but Napoli lose to Fiorentina

 

Nigeria striker Victor Osimhen bin dey on di score sheet again for Napoli on Sunday but di Serie A champion title defence still dey turmoil as anoda defeat leave dem seven points off top spot.

Ironically, say e miss penalty wey lead to di social media storm wit Napoli, na from di spot wey di 24-year-old bin draw im side level on di stroke of half-time wit Fiorentina but di visitors bin go on to claim one 3-1 win for dibfinal match bifor di international break.

Na Napoli second defeat inside eight games and leave dem for fifth spot - seven points behind leaders AC Milan.

Despite di mocking for TikTok by im own club, di first African to finish leading scorer for di Italian top flight, Osimhen, for di aftermath don enjoy global support including from Arsenal legend, Thierry Henry.

Wit hindsight, maybe e always dey unavoidable say some of di kasala wey cover Napoli following dia Scudetto success no go only play out on di pitch in terms of results, but go directly affect dia biggest star personally.

Di unwise decision of club president Aurelio De Laurentiis go trigger extension to former manager Luciano Spalletti contract put di 64-year-old nose out of joint so much so say e resign wit Frenchman, Rudi Garcia, dey appointed for im place.

For one sense, dis latest incident wit Osimhen fit look like continuation of one theme of poor judgements on di part of di reigning Italian champions.

Similarly to di handling of Spalletti, Napoli approach to address Osimhen anger over di TikTok posts wey dem don delete, wey bin use am laff sake of di missed penalty against Bologna, don endanger wetin suppose be season of consolidation for di club following dia first title win for over 30 years.

Osimhen - 'Di love I enjoy for Napoli dey massive'

Inside all of dis, Osimhen, don largely keep im own counsel, content to allow im football do di tok-tok.

Di Nigerian immediate reaction - delete di majority of di allusions to Napoli from im Instagram account - bin draw mixed reactions, but unfortunately dey viewed by some of di club fanbase as rejection of dem.

Dis fit no dey farther from di truth wit subsequent Instragram post wey call for unity and previous statements make no secret of im special connection to di Partenopei faithful, dey go so far as to put im success down to dia warmth and support.

"Di love I enjoy dey massive - di club, di city, di supporters and everyone bin connect to Napoli make me fly,"  tell BBC Sport for 2021.

"Dem trust me and stand by me through di tough start last season."

Nigeria Balon d'Or and Fifa Di Best nominee

Despite all di ties wey don happun around and relate to Osimhen over di past two weeks, im attention don already shift to dey able to deliver on di pitch wia e count.

Im goals against Udinese, Lecce and now Fiorentina no leave room for doubt as to im commitment. Now e come be di club right to see to im contract extension wit di current deal wey go expire for end of next season.

For di middle of di gbege, e fit dey easy to loose sight of di most important tin: di Nigeria international now dey enjoy finest period of im career to date.

For September, e dey nominated for both Ballon d'Or and Fifa Di Best awards, and be di frontrunner for di African Player of di Year award.

For one season of unprecedented abundance for Nigerian striking ranks, e be di national team undisputed leading marksman for di club level.

E now don join up wit im kontri squad for di international friendlies against Saudi Arabia and Mozambique, afford am di opportunity to once again connect wit one adoring fanbase.

Dis na di best days of Osimhen life; in spite of everitin im Super Eagle kotinu to fly\


wellspring:BBC NEWS


Post a Comment

Previous Post Next Post